When be Eid Fitr 2022? Moon no show for Saudi Arabia, Eid go be on Monday May 2
When be Eid Fitr 2022? Na questions many dey ask as Moon no show for Saudi Arabia on Saturday.
For Islamic Lunar Calendar, di first day of di month of Shawwal na im dey mark di festival of Eid-ul-Fitr across di world.
Muslims across di world dey ginger up to see di crescent moon tonight to celebrate Eid-ul-Fitr wey be di end of Ramadan.
When be Eid Fitr 2022 in Nigeria?
For Nigeria, di Supreme Council for Islamic Affairs ask Muslims all over di kontri to look for di new moon of Shawwal on Saturday.
Dis na as di 1443 Hijra (2022) Ramadan don almost end.Di council give dis message under di leadership of im President-General and di Sultan of Sokoto, Alhaji Muhammad Sa'ad Abubakar III.
Director of Administration of di NSCIA, Zubairu Haruna Usman-Ugwu, tok dis one for statement wey im bin release on behalf of di Sultan, on Friday.
"If Muslims wit beta character see di crescent,den His Eminence (Sultan) go declare Sunday, May 1st 2022, as di 1st of Shawwal and di day of 'Idul Fitr.
Im also ask Muslims to in di spirit of Ramadan, to remember say Zakatul Fitr (special Ramadan charity) na compulsory food-levy wey dem impose on Muslims wey get, to give to di less privileged for society.
Want More Stories Like This Click The Below Button